Reekado Banks: Wizkid blast Reekado Banks insult for 'Omo Olomo' inside EndSARS protests

Reekado Banks and Wizkid

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto,

Wizkid blast Reekado Banks 'Omo Olomo' drop inside EndSARS protests

Ayodeji Ibrahim Balogun AKA Wizkid blast fellow singer Reekado Banks for droping 'Omo Olomo' at a time wen most Nigerians dey tok about #EndSARS protests.

Wizkid wey don postpone di release of im fourth studio album, 'Made in Lagos' because of di ongoing protests, blast Reekado Banks and call am a clout chaser.

Trouble start wen Ayoleyi Hanniel Solomon AKA Reekado Banks tweet say im latest single title 'Omo Ologo' wey feature Wizkid dey drop on Friday and e include di #EndSARS hashtag for di post:

"Out of control, gbedu must drop. Dis one wit my brother @wizkidayo "OMO OLOMO" midnight dropping Fire Still on di matter !!! #EndSWAT #EndSARS #EndPoliceBrutality,'' Na so im tweet read.

Wia dis foto come from, Sceenshot

But Wizkid reply, "Delete dis dude ! I no fit believe say you even dey do dis at a time like dis. Old song ! #endsars f**l!"

Wizkid don since delete im tweet and response on Reekado post.

Wia dis foto come from, Screenshot

Reekado Banks still keep im post up ontil Friday morning and as at wen BBC Pidgin publish dis tori.

However many of Reekado Banks fans vex for am, while odas no like di kain reply wey Wizkid send.